Adebayo Adelabu
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Fest nem | Adebayo |
| Wen dem bon am | 28 September 1970 |
| Ples wey dem bon am | Ibadan |
| Fest langwej | Yoruba Langwej |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
| Wok wey e dey du | politician |
| Wie e go skul | Obafemi Awolowo University |
| Party wey e dey for politis | All Progressives Congress |
| E pipul | Yoruba pipul |
Adebayo Adelabu (dey bon am 9 September 1970) na Naija pesin wey bi forma deputi govno of Sentra Bank of Naijiria. Adelabu don olso wok as di fediral minista of pawa for Naija. E risain on 22 April 2026. Adelabu don kolet eleshon tiket in Oyo Stet mek pipul fit vote for am as govno onda di APC parti for 2019
Hau im tell stat laif an go skul
chenj-amNa di famili of Aderibigbe Adelabu of Oke-Oluokun kompod, Kudeti Aria in Ibadan. Na Adegoke Adelabu bi im gra-pa. Adelabu go Ibadan Guvmet Primari Skul, wey de Agodi Ibadan fom 1982 go rish 1987. Adelabu risiv e fest klass digree in Akauntin fom Obafemi Awolowo Yunivasiti. E stil get ICAN satifiket. Adelabu na Chartered Institute of Banka of Nigeria an e na Associate memba of Institute of Daretor of Nigeria an di United Kindom. Adelabu don olso go rid for som korse for difren bizness skul wey inklud skul wey de Harvard, Stanford, Wharton, Columbia, Kelloggs, an di Yunivasiti of London.
Hau e tek wok
chenj-amNa PriceWaterhouse ( nau dia nem na PriceWaterhouseCoopers) wey bi one Intanashonal kompini of Chartered Akauntat an Manejimet Konsotat bi di fest kompini wey Adelabu wok. Dorin di seven yies wey Adelabu yuz for di kompini, e elp chuk eiyes an audit for big big bank an finashial kompini wey de insaid an outside Naija. Adelabu de wen Dem wan du do adjosmet for Sentra Bank of Naijiria wey hapun in 1999 an e im lid di finans tim on di CBN ri-enjinerin an korpret reniwa projet wey dem nem ""Project EAGLES". In di yier 2000, Adelabu komot fom dia as dia audit manija an sinior konsotat to go join First Atlantic Bank as dia Finanshial Kontrola an Grup Hed of Risk Manejimet an Kontro. Dey leta mek Adelabu dia shif inspetor of di bank in 2002. Adelabu bikom dia Grup Hed of Nashonal Poblik Sektor Bizness in 2003. Adelabu komot go Standard Chartered Bank to go wok as di West Afrika Rijional Hed of Finans an Stateji (Konsuma Bankin Bizness) wey get one ofis for Legos an anoda one for Accra. Adelabu de dia til 2009 bifor e kom to bikom di Ezekutiv Daretor/Shif Finanshial Ofisa (CFO) of Naija lagest bank First Bank of Nigeria Plc, at di age of 39. For February 2014, forma presidor, Goodluck Ebele Jonathan chuz Adelabu as di Deputi Govnor of Sentra Bank of Nigeria (CBN).